Nigerian Passport: Nigerian immigration portal to apply go reopen June 8 at midnight - See step-by-s

8 June 2021

Nigeria Immigration Service oga don announce di reopening of Passport application and payment portal starting from 12 midnight June 8, 2021.

Comptroller General, Muhammad Babandede say di reopening go allow eligible passport applicants to apply and make payments for di various categories of passports.

Nigeria Immigration Service bin suspend fresh passport application for May to clear di backlog of passport application wey don already dey ground.

But with di reopening wey go begin from midnight today, new Passport application and payment regime don start.

Process to get Nigerian Passport and How di New Passport regime go be

  • Applications and payments for Passport services for dis new passport regime wey go start from 12 midnight June 8th 2021 go be through di Immigration Service website.
  • Applicants need to visit di portal to apply and upload dia support documents for vetting and processing. To guide applicants through di application and payment process, chat room facility go dem for di portal to assist dem.
  • Afta successful applications, applicants go make dia online booking interview/enrolment appointment for any day, time and location wey dey convenient for dem.
  • Di new timeline for Passport production and issuance afta applicant don successful enrol for di selected Issuing Centre go be six weeks for Fresh applications and three weeks for Re-issue (Renewal applications)
  • Nigeria Immigration no go allow applicant wey neva make online application and payment to enta any of di Passport Issuing Centres for Passport processing
  • Dem go contact applicants through email and phone number wey dem provide during application wen dia Passports don dey ready
  • Should in case of any problem, challenges and feedback, NIS don provide help line wey pipo go call.

Oga Babandede use dis opportunity to advise Nigerians and Passport applicants make dem no meet touts to help dem because di whole passport process dey easy now.

E warn those wey dey do business with di Passport application to stop or else dem go face very strict sanctions.

President Muhammadu Buhari in July 2019 order say di Nigerian Security Printing & Minting Company go be di only company to dey produce e-passports for Nigerians.

Why Nigeria bin suspend International passport issuance?

Nigeria Immigration Service bin suspend fresh passport application for May 2021 to clear di backlog of passport application wey don already dey ground.

Di "situation no go allow di Nigerian Immigration Service to accommodate new applications especially as we dey consider our desire to ensure say pipo wey come to our offices comply wit all di COVID-19 protocols.

Na wetin di Comptroller General of di Nigeria Immigration Service, Muhammad Babandede bin explain give kontri pipo.

Im tok say dem don direct Passport Control Officers to continue to send out short message notifications for collection to all applicants wey don submit.

Those wey submit functional contact details/numbers for dia applications na im dem send notice to.

Dis na as "dem dey intensify effort to clear up di remaining applications for some Centres."

Different categories of Nigeria new travel document

Nigeria Immigration Service [NIS] recently introduce a new travel document "Nigeria Temporary Passport" for Nigerians abroad wey need to travel back home but no hold standard passport for hand.

Na for March 2021 Nigerian goment officially launch di new temporary type electronic passport [e-passport] dem call Nigeria Temporary Passport to replace paper-based Emergency Travel Certificate.

Apart from di temporary passport, oda travel documents like di diplomatic [red] passport and Ecowas passport dey wey di immigration service dey issue.

Two types of passports dey for all dis categories wit 64 or 32 pages; Di five and 10-year duration international passport.

Di one of 10 years cost pass di one of five. Na President Muhammadu Buhari goment introduce 10-years valid period for Nigerian International Passport.

Nigerian Passport processing time

Nigeria Federal Government for April say dem dey turn around di entire passport application process by di Nigeria Immigration Service (NIS) to Six weeks.

Di reason na to ensure seamless, transparent, plus give human dignity to applicants and fulfil citizenship integrity, in line wit di mandate of di Ministry of Interior.

Di kontri Minister of Interior, Rauf Aregbesola say:

"We get plenti challenges in di past, wey include shortage of booklets, touting, racketeering, increasing di cost, passports being issued to ineligible persons, among others.

Dem go create special centres for quick services. Dis special centres go run on public-private partnership basis.

Nigeria Immigration Service don already start for Abuja and e say 10 more centres go open in coming weeks.

Nigeria passport only fit cari pesin wey get am enta 46 kontris visa free.

ncG1vNJzZmivp6x7o67CZ5qopV%2BltqWzyKdmraeinnp2g5NpaXBwYQ%3D%3D